Emem Isong
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Emem Isong |
Orijina nem | Emem Isong |
Fest nem | Emem |
Wen dem bon am | 20. century |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
Wok wey e dey du | film producer, screenwriter, film director |
Wie e go skul | University of Calabar, Federal Government Girls College, Calabar |
Rilijon | Catholicism |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Official website | https://www.youtube.com/@EmemIsongTV |
Personal pronoun | L484 |
Emem Isong na Naijá aktres wey bi fim raita, fim produsa an fim dareto. Pipul no am wel wel for Inglish langwej fim.Di sekond fim wey Emem daret na "Code of Silence" an di fim tok abaut mek dem dey yuz by pawa dey slip wit wuman (Rape). Dey rilis di fim for 2015.
How e tey stat life an di skul wey e go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Emem na di nomba 4 pikin of di 5 pikin wey im papa an mama bon.Na September 5 dem bon Emem an e papa kom fom Ikono Lokal Govament Aria of Akwa Ibom Stet in Naijá.Emem rid Theater Art an kolet Bachelor digri fom University of Calabar. Isong get diploma Satifiket in Computer Science fom di Computer Science Institute (NCR).
Tori of e karia
[chenj-am | chenj-am for orijin]Emem Isong Karia in fim mekin stat in 1994 wen e rait an dey amog di produsa of di fim Jezebel. Di fest fim wey Emem produs by imsef na Breaking Point (1996). Emem yuz 8 years wok wit Remmy Jez to produs Remmy Jez fims.For 2008, e stop to dey wok wit Remmy Jez. Afta dat, Emem join produs Feloaded(2008).Emem don rait an produs meni fims laik:
- Reloaded
- Breaking Point
- She Devil
- A Minute To Midnight
- Play Boy
- Private Sin
- Master Stroke
- Rumours
- Shattered Illusion,
- Promise Me Forever
- Emotional Crack (2003)
Dat last fim na im dey sho for African Fim Festival in New York City. Pipul wey no Yoruba langwej fim no sey Emem na koret produsa.Di fim wey Emem dey mek dey mek niu aktress popula bikos e mek aktress like Stephanie Okereke, Dakore Egbuson an odas popula wel wel. In 2014, Emem daret e fest long fim Champagne wey dem sho for Silverbird Galleria in Victoria Island, Lagos. In August 2015, Emem rilis e sekond long fim wey e daret Code of Silence an e wok wit di Royal Arts Academy an Nollywood Workshop an intanashional Organisashion wey Govament no dey chuk mouth put (NGO) wey dey try wan chenj di sosaeti wit fim wey dem dey du.Di fim tok abaut to dey pawa slip with wumen wey Oyinbo dey kol Rape for Naijá.Di pipul wey akt insaid di fim na Makida Moka, Patience Ozokwor, Ini Edo, an Omoni Oboli an odas.Emem Isong’s brain an sens for fim mek dem chuz am as Spika for expertise in di muvie industri don allow ha bi chosen as a spika in di Afrinolly masterclass seris an also as a jorgi maga for di MTN Afrinolly short flim completion in 2013.Evri fim wey Emem Isong du, e dey wan mek pipul enjoi am wel wel.
Wai pipul no fit forget am
[chenj-am | chenj-am for orijin]Emem Isong nem de di nem of produsa wey dey mek fim wey rili mek sens wey New Nollywood Movement du.E fim na standard wey Naijá kontrie fit sho for eniwie in di wold bikos of di levu of prodosion wey e dey put for e fim-dem.
Emem Isong dash moni to fom The Royal Art Academy in 2010 an na im bi di CEO of di Akademi. Emem stat di Akademi wit Uduak Oguamanam, Anietie Isong, and actress Monalisa Chinda. Di Akademi dey for Surulere, Legos Stet, Naijá. Di Akademi tok sey e go mek suo sey e hep di student to mek an produs fim wey go get sens and beta wey pipul fit luk wel wel in Naijá or Oyinbo kontris.
Pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Emem hosband na Misodi Akama an dey get twins wey Emem bon in 2016. Emem don bon one boi bifor e mari Misodi Akama.
Fim wey e rait or folo rait
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | nem of di fim |
---|---|
2020 | Special Jollof |
2016 | Ayamma |
2015 | Don't Cry For Me |
2014 | Apaye |
Knocking on Heaven's Door | |
2013 | Forgetting June |
2012 | Silver Lining |
2011 | I'll Take My Chances |
2010 | Kiss and Tell |
Bursting Out | |
Holding Hope | |
Memories of War | |
2009 | Edikan |
2008 | Reloaded |
2007 | A Time To Love |
Unfinished Business | |
Yahoo Millionaire | |
2006 | Games Men Play |
Traumatised | |
2005 | Behind Closed Doors |
Darkest Night | |
Endless Lies | |
Games Women Play | |
Girls in the Hood | |
I Feel U | |
Men Do Cry | |
2004 | Critical Decision |
For Real | |
Masterstroke | |
Promise Me Forever | |
2003 | Private Sin |
1996 | Breaking Point |
1994 | Jezebel |
Fim wey e daret or folo daret
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | Di nem of di fim |
---|---|
2014 | Champagne |
2015 | Code of Silence |
Awods
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Emem win Best produsa for di fim Memories of my Heart atZAFAA Awards
- Emem win Outstanding awod from Wow Divas for di wey e tek hep pipul no abaut wetin pipul wey get sikness dey faze wit e fim Silver Lining (2011)
- Emem win speshal rekonisashion awod by Best of Nollywood
- Indostrie Merit Awod fom Ntanla Awods
- Emem win Africa Movie Awards for di Katigori of Best Scriptwriter for di fim Reloaded (2008)
- Emem win Best Producer of the year an Best Screenplay for di fim Reloaded (2008) wey City People Award du.
- Emem win Nigeria's Integrity Film Awards (HomeVida) in di Katigori Family/Child Friendly Category for di fim Knocking on the Heaven Door (2014).